Fela Kuti
Lyric guide

Authority Stealing

Authority Stealing lyrics by Fela Kuti. [Chorus] Authority stealing! You be thief (I no be thief) You be rogue (I no be rogue) You dey steal (I no dey steal)...

Fela Kuti visibility8 visits Video on page
person Curated by Ethan Walker LyroVerse team
Lyrics

Authority Stealing

The lyric stays readable and compact here; the note and related paths sit nearby so you do not lose the song while looking for context.

[Chorus]

Authority stealing!

You be thief (I no be thief)

You be rogue (I no be rogue)

You dey steal (I no dey steal)

You be robber (I no be robber)

You be armed robber (No be armed robber)

I no be thief (You be thief)

I no be rogue (You be rogue)

I no dey steal (You dey steal)

I no be robber (You be robber)

I no be armed robber (You be armed robber)

[Chorus]

Argument, argument!

Argument, argument, argue

Them argue

Everbody dem argue

Them dem dem argue

Up and down them argue

Everbody dem argue

Them dem dem dem argue

Yes yes, them argue

Everbody dem argue

Argument about stealing

Somebody don take something

Wey belong to another person

Then you go hear:

You be thief (I no be thief)...

On top of the road, on the side

People dey waka

Office workers, labourer workers, workers' workers

Them go dey waka

Inside bus them go dey

Motorcycle them dey ride

Plenty, plenty crowd

Inside this crowd

Sometimes for one corner

Sometimes for one street

You go dey hear: ha ha!

[Chorus]

Thief, thief, thief!

Rogue, rogue, rogue!

Robber, robber!

Catch am, catch am! Thief, thief, thief!

Catch am, catch am! Rogue, rogue, rogue!

Catch am, catch am! Robber, robber!

Catch am

Pull am

Get am

Keep am

Ole...

[Chorus]

Catch am, catch am!

Looking go start

Watching go start

Chasing go start

Somebody go dey

Wey them go grab

Them go beat am well-well

Them go lynch am well-well

Police go come well-well

Them go carry am go court

Them go put am for jail

Them fit put am six months

(Them go put am for one year)

Them fit put am two years

(Them go put am for five years)

Them fit put am seven years

(Them go put am for ten years)

If not them go shoot am well

Them go shoot am for armed robbery

On top of the road, on the side

People dey waka

Office workers, labourer workers, workers' workers

Them go dey try

To try to make ends meet

Them go dey hustle

To try to make ends meet

Them go put hands for back

To try to make ends meet

Them go dey beg oga

To try to make ends meet

Them go be slaves for them town

To try to make ends meet

I say turn your face small

To the right wing

Oga patapata dey for there

Authority people dey for there

Instead of workers

We have officials

Instead of buses

Them dey ride motor-car

Instead of motorcycle

Na helicopter

Instead of them waka

Na worker go waka for them

Authority people them go dey steal

Public contribute plenty money

Na authority people dey steal

Authority man no dey pickpocket

Na petty cash him go dey pick

Armed robber him need gun

Authority man him need pen

Authority man in charge of money

Him no need gun, him need pen

Pen got power gun no get

If gun steal eighty thousand naira

Pen go steal two billion naira

[Chorus]

Thief, thief thief!

Rogue, rogue, rogue!

Robber, robber!

You no go hear them shout

You no go hear them shout at all

You no go hear them say

You no go hear them say response at all

Na different way be them way

Na civilize style be them style

[Chorus]

Yes, yes, yes, yes!

"Oh yes, of course, contract, have some money back in hand, ha ha"

Hear the words them dey take deceive the people:

Misappropriation

Maladministration

Nepotism

Mitigation

Make I remember another one wey them dey use

Defraudment

Forgerylization

Embezzlement

Vilification

Mismanagement

Public inquiry

Authority stealing pass armed robbery

We Africans we must do something about this nonsense

We say we must do something about this nonsense

I repeat, we Africans we must do something about this nonsense

Because now authority stealing pass armed robbery

Authority man him go dey steal

Public contribute plenty money...

[Chorus]

Authority stealing!

Quick answers

What this page can answer fast

Who performs "Authority Stealing"?

Fela Kuti performs "Authority Stealing", and this lyric page sits inside the Fela Kuti catalog on LyroVerse.

Are there related songs to explore after "Authority Stealing"?

Yes. The related section below points to No Agreement and Fear Not for Man with a short reason for opening each page next.

Where can I find more songs by Fela Kuti?

Use the artist link near the top of the page or the related paths section below to keep moving through Fela Kuti's lyric pages.

Song Room

Interpretations, questions, and corrections for this song

Interpretations, questions, memories, and correction notes live together here. The room stays noindex while the best insights are reviewed.

Open Song Room
0 followers Selected insights only surface after moderation
Listener comments

What people are saying

0 comments
Add a short interpretation or memory

A strong comment here is specific: the phrase you keep hearing, the mood you come back for, or the reason this song stays in rotation.

Sign in to post the first listener note. Reporting stays open to everyone.

No listener comments on Authority Stealing yet.