Iya Basira
Read Iya Basira lyrics by Styl-Plus on LyroVerse, with linked artist context and related song paths.
The page facts to cite before the commentary
Use this page for the lyric text, linked artist context, and any LyroVerse editor's note attached to the song. Listener comments remain user-generated and should not be treated as the primary source.
Iya Basira
The lyric stays readable and compact here; the note and related paths sit nearby so you do not lose the song while looking for context.
Dis na one buka wey I dey like to go. The food sweet so
tey e go make your mind blow. Day and night Iya Bass!
How she do am I no no. Dem tink say na jazz, my
brother no be so.
CHORUS: People people make una come e oh, iya
basira e don jazz me oh, oh oh oh, everybody helep
save me oh, I no dey sabi chop either my mother or my
girlfriends food, People people make una come e oh,
iya basira e go kill me oh, oh oh oh, everybody helep
save me oh, I no dey sabi chop at my mother or my
girlfriends food.
VERSE 1 wetin dey be say e get one day, wey I
say I go play go see my paddy Sunday; na so I reach
there but Sunday he don high on bear, luckily for me
in junior brother eye e clear, so e say make we stroll
through the area, little did I know I was strolling to
my burial right there where Oshodi bus dey load, was a
little buka, close to the main road. I laugh when e
pass the door, he tell me say the name na "Iya Bas"
for short, but I bow when he order "iresi ati ewa,
eran umum pure water not even minerals. I come gree
say I go manage to chop am, before I realize I dey
order second round, third round, fourth round, I never
still stop wetin Iya Basira e give me chop.
VERSE 2 you think say na play when I say that
the way wey I dey (wetin do am?)e no dey okay,wetin be
your own advice, I don dey steal my paddy money to buy
Iya Basira rice even on my girlfriends birthday, wey
she dey wait make I take am to Ocean View, I no know
when I pass di place, the only thing wey dey my mind
na Iya Basiras palm oil stew, kilon kilon sele sele,
me I never see this kind, juju tele tele, all those
people wey go vex pele pele but I hear say iya basira
na xxxx xxxx I sure say still I go go their go sit
down order my first round move to second round, third
round, fourth round I no dey ever stop. Wetin iya
basira don give me chop?
BRIDGE Officer abegi follow me to the place
everybody don telle me I dey craze my girl friends don
leave me, my mother no gree see me, my paddy hmm iya
basira you don kill me.
Oya people people make una stop officer e don come
(Policeman: where the woman?)
Woman: i dey inside, oga I dey come.
Policeman: Woman wetin you dey give people chop wey
dey cause all this wahala, casala oya make we talk.
Woman: Oga sir true to God nothing wey I dey put for
the food wey I dey cook na God dey make am good. Na
which kind talk be that sey na God dey cook the food
abi you think say I be fool, no be juju you dey put?
In fact I dey suspect say na **** you wash put sotey
people dey queue come dey rush for your stew
Policeman: Well, to confirm am me I no mind make I
chop small give me fufu ninety naira plus dat soup wey
dey draw.. chai correct this food sweet no be small she
una no go vex if I still order for more
Woman: Officer no worry na de food be dis
Policeman: Oya people people make una go case
dismissed
What this page can answer fast
Who performs "Iya Basira"?
Styl-Plus performs "Iya Basira", and this lyric page sits inside the Styl-Plus catalog on LyroVerse.
Are there related songs to explore after "Iya Basira"?
Yes. The related section below points to Drives Me Crazy and Always On My Mind with a short reason for opening each page next.
Where can I find more songs by Styl-Plus?
Use the artist link near the top of the page or the related paths section below to keep moving through Styl-Plus's lyric pages.
Interpretations, questions, and corrections for this song
Interpretations, questions, memories, and correction notes live together here. The room stays noindex while the best insights are reviewed.
What people are saying
No listener comments on Iya Basira yet.
A strong comment here is specific: the phrase you keep hearing, the mood you come back for, or the reason this song stays in rotation.
Sign in to post the first listener note. Reporting stays open to everyone.